Search

Brunella Oscar, Williams Uchemba traditional marriage photos, tori and celebrity messages - BBC News

Instagram/williamsuchemba

Some Nigeria celebrities don shout big congratulations to popular Nigerian child actor wey don turn comedian now, Williams Uchemba as e do im traditional marriage ceremony to e sweetheart Brunella Oscar over di weekend.

Comedian Ayo Makun AKA A.Y share di traditional marriage foto of di couple and wish dem God blessings while musician J Martins wish Uchemba wey e call 'childhood' friend and 'brother' happy married life.

Instagram/Aycomedian
Instagram/officialjmartins

Di traditional marriage between Williams Uchemba and Brunella Oscar take place for Alor, Anambra state, wia im wife from come.

Dis dey happun afta some weeks ago wey Williams Uchemba bin propose to Brunella and post give im fans for social media say time don reach for am to settle down.

E later come reveal say di white wedding go take place November 21, 2020 wia di ogbonge showdown go happun live with enof groove.

Uchemba wife na physician for Hill York Medical.

Instagram/williamsuchemba
Instagram/williamsuchemba
Instagram/williamsuchemba
Instagram/williamsuchemba
Instagram/williamsuchemba
Instagram/williamsuchemba
Instagram/williamsuchemba
Instagram/williamsuchemba
Instagram/williamsuchemba
Instagram/williamsuchemba
Instagram/williamsuchemba
Instagram
Instagram/ten10_drummerboi
Instagram/official_djalonso

Who be Williams Uchemba

Instagram/williamsuchemba

Williams Uchemba start im career for movies for early age wia im gain popularity for films like 'Beyond Belief' and 'The World of Riches.'

E recently come back as social media comedian wey popular sotey e carry am enter music with im popular catch phrase, "I don't like what I hate."

For 2018, Actor Williams Uchemba win Individual Social Philanthropist and Best of Social Media award.

Uchemba na im bring di social media campaign, 'Project One Million' come wey wan helep poor pipo comot poverty through education and skills plus including how poor pipo fit get cheap house so evri bodi go get roof on top dia head.

Later dat year 2018, one controversy of fraud surround Uchemba afta one human right activist, Edafe Okoro share screenshot of how di child actor dey claim to be United Nations ambassador.

Edafe Okoro claim say Uchemba request money from am to pay, so dat e go put am among delegation to United Nations youth event for US.

According to di screenshot wey go viral on social media, Edafe alert di United Nations Youth Envoy, Ms Jayathma Wickramanayake wey later tweet say dem no get any representative for Nigeria.

Uchemba deny di allegation from Edafe plus di claim wey say im dey pose as United Nations ambassador. E say na di handwork of pipo wey dey impersonate am for social media

Let's block ads! (Why?)



"traditional" - Google News
November 17, 2020 at 05:07PM
https://ift.tt/3f8Oi2s

Brunella Oscar, Williams Uchemba traditional marriage photos, tori and celebrity messages - BBC News
"traditional" - Google News
https://ift.tt/36u1SIt
Shoes Man Tutorial
Pos News Update
Meme Update
Korean Entertainment News
Japan News Update

Bagikan Berita Ini

0 Response to "Brunella Oscar, Williams Uchemba traditional marriage photos, tori and celebrity messages - BBC News"

Post a Comment

Powered by Blogger.